Barbeash (Stolen poem from an agbero’s journal)

Ohizei Egbokhare
1 min readSep 30, 2021

I say make I go barbeash

See how wind dey blow

Na one day me sef go blow like wind

Blow like sand

Blow like Ikeja in 2002.

Na so sand enter my shoe

I for wear palm

Na mistake wey I no go make again

Na why mistake dey be dat

Make am once come no make am again

Mistake be like coffin.

I say make I show barbeash

See as families dey jolly

One pikin don dey enter water

E no sabi baff

Water no get enemy

But e wicked die.

I say make I come barbeash

E get some bané wey dey here

Dem just dey snap foto

Dem never gree look the water once

Dem just dey pose like fowl wey car match hin leg

Dey go comot nownow.

I say make I come barbeash

Because me sef be man

And man suppose reason one or two

Na where peace dey mind dey open

Dem no dey write waec for club

Na where mind open

Na him road dey clear.

--

--